CHAN 2014: Libya Knows Football More Than Ghana

0
Wpid Libya
Chan 2014: Libya Knows Football More Than Ghana

Note: this article is written in Pidgin English for a Ghanaian or Nigerian audience

Libya don colet dis year CHAN (na African Nations Championship be de full name) title afta dem carri penarity bilala Ghana for final, inside Cape Town Stadium on Saturday nite.

Libya don defeat Ghana don win CHAN

Libya don colet dis year CHAN (na African Nations Championship be de full name) title afta dem carri penarity bilala Ghana for final, inside Cape Town Stadium on Saturday nite. 

De two contri bin play diasef pass estra time, come enta penarity. Libya waya Ghana 4-3 for de pena, to win dia fes coret Cup for Africa.

Na de third strait match wey Libya carri pena win, afta dem use pena kolobi Gabon for kwatafinal, bifor dem use am troway Zimbabwe for semifinal sef.

Notin too hapun for fes haf, wen match start, as de two contri bracket diasef, but Ghana resembu pipu wey fit carri power score, and Libya resembu pipu wey for use counter score.

Match jus reach second minit sha, wen Ghana see beta chance to score. Ghana strika, Siedu Bansey run enta Libya 18, nod one helele header from one coret nasa, but Libya goalie, Mohamed Nashnush dive, catch am.

Libya sef, come show diasef, as Elmutasem Abushnaf colet one sweet pass, face Ghana post. Ghana goalie, Stephen Adams rush comot for post, colet de ball from Abushnaf leg.

Na onli dose two chance bin dey de whole fes haf sha, as de two contri jus play worwor ball for fes haf.

Na till match pass 60 minit, bifor Ghana see anoda chance to score sef. Aseidu Attorbrah sama shot from outside 18, but Libya goalie, Nashnush no even tension at all.

As match reach 79 minit, Libya come dey halla for penarity afta Ghana defenda, Abeiku Ainooson carri hin bodi block one helele shot, but refree jus bone dem bicos de ball no touch hin hand.

As match reach 90 minit, nobodi shock say na 0-0 bicos de two contri no jus gree attak well, well, so e enta estra time. Libya for score sharp goal as estra time start, afta Elmehdi El Houni nasa one helele ball enta Ghana 18. Libya strika, Abushnaf jus nod de ball pass side net!

As second haf of estra time start, Ghana sef see chance, but Abdul Mohammed troway de ball, bifor Libya see de bes chance of de whole match. Strika, Abdelsalam Omar dive, nod one kin ball wey all man don shout ?goal!? finish, but Ghana goalie, Adams, save am!

As nobodi fit score, de match come enta penarity. Ghana troway dia fes two pena, as Libya goalie, Nashnush catch faya, bifor Libya sef troway dia las two, as Ghana goalie, Adams sell hin market.

As de pena enta ?fes to troway?, Ghana playa, Tijani Joshua troway hin own to helep Libya win de match 4-3.

Libya 0 Ghana 0

Libya win Ghana 4-3 wit penarity.

How de penarity hapun: (Libya fes kick) Faisal Ali score 1-kondo; Michael Akuffo troway (goalie catch am) 1-kondo; Muataz Fadel score 2-kondo; Abeiku Ainooson troway (goalie catch am) 2-kondo; Ahmed Almaghasi score 3-kondo; Aseidu Attorbrah score 3-1; Mohamed Elgadi troway (goalie catch am) 3-1; Godfred Saka score 3-2; Abdelsalam Omar troway (goalie catch am) 3-2; Jackson Owusu score 3-3; Ahmed El Trbi score 4-3; Tijani Joshua troway 4-3.

Libya squad: Mohamed Nashnush, Ahmed Almaghasi, Ali Salama, Ahmed Alwani, Ahmed El Trbi, Almoatasembellah Mohamed, Elmehdi El Houni, Faisal Ali, Mohamed Elgadi, Elmutasem Abushnaf (Muataz Fadel enta for am), Mohamed Ghanudi (Abdelsalam Omar enta for am).

Ghana squad: Stephen Adams, Godfred Saka, Nuru Sulley, Abeiku Ainooson, Tijani Joshua, Anobaah Theophilus (Abdul Mohammed enta for am), Aseidu Attorbrah, Jordan Opoku (Jackson Owusu enta for am), Michael Akuffo, Siedu Bansey, Sulley Mohammed (Yahaya Mohammed enta for am).

View the original article here

Send your news stories to [email protected] Follow News Ghana on Google News

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here